Facebook Twitter Instagram
    Priya Saha
    • Home
    • বাংলা
    • Minorities-Bangladesh
    • Minorities-Global
    • About
    • Contact
    Facebook Twitter Instagram
    Priya Saha

    Kontris wey don ban Twitter & how citizens dia dey tweet – BBC News Pidgin

    June 5, 2021By Priya Saha
    "Twitter ban in Nigeria": [How to use Virtual Private Network 'VPN' tweet]
    5 June 2021, 10:00 WAT

    New Informate one hour wey don pass

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Ban on Twitter, Facebook, Internet Shutdown and online censorship no be new tin again at all.

    Yes o! Authorities for some kontries don bin carry out dis actions before, particularly to suspend Twitter.

    Nigerian goment na di latest to to ban [Twitter] di micro blogging site operations for undermining dia goment alias ‘interference’.

    One report for 2018 don reveal say up to 22 African goment don order network disruptions for di last four years.

    Na Di Collaboration on International ICT Policy in East and Southern Africa (CIPESA) bring out dis report.

    And since 2019 Algeria, Democratic Republic of Congo, Chad, Gabon, Sudan and Zimbabwe – don experience internet shutdowns.

    Nigeria ban Twitter

    On Friday June 4, Nigeria Federal goment announce say dem don suspend di operations of Twitter inside di kontri till further notice.

    Federal goment say dia decision na sake of di “constant use of Twitter for activities wey fit damage di kontri corporate existence.”

    Dis ban dey come just two days afta Twitter bin delete one tweet from President Muhammadu Buhari.

    Di deleted Buhari Tweet bin mention di Nigeria civil war and warn those wey dey attack goment buildings.

    So Nigeria don join di list of oda kontries for di world wey don ban twitter and oda social media platforms.

    [Twitter ban] See kontris wey don suspend Twitter

    China

    For 2009, China block Twitter for temporary.

    Na afta small group of Muslim ethnic minority (Uighurs) inside di kontri use di site to exchange information.

    Di message wey dem share for di micro blogging site later lead to serious riot for Xinjiang.

    Afta di goment take dat decision many pipo for China begin use VPN to access Twitter.

    Later on, authorities come officially block twitter togeda with Facebook and oda social media platforms.

    Turkey

    For 2014, Turkey block Twitter.

    Turkish telecommunications regulator cite one court order to apply “protection measures” on di website.

    President Recep Tayyip Erdogan wey bin promise to “wipe out Twitter” say e no care wetin di international community go tok.

    But presido Erdogan later lift di ban for April 2015.

    Egypt

    During di 2011 protest for Egypt, Twitter claim say authorities for di kontri block dem.

    But di Egyptian goment deny say dem no take any action to restrict use of twitter.

    Herdict, one project from Harvard University wey dey collect data about websites wey dey down, write many reports say Twitter dey down during di protests. But afta one week, pipo come later fit tweet.

    North Korea

    North Korea start to dey block Twitter and oda sites for April 2016 – and previously for late 2014 – to stop di spread of information.

    Infact Internet access for North Korea dey restricted to small section of di top ogas wey must receive state approval to use am.

    How citizens inside kontris wey block twitter dey tweet?

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Most Pipo for dis kotries wey dia goment ban Twitter dey either use VPN or alternative social meida platforms like Weibo as in di case of China

    Virtual private network (VPN) dey help pesin browse di internet anonymously (Without no identity).

    E dey allow pesin get access to content wey authorities don block for im kontri.

    [VPN] – How to use Virtual Private Network tweet

    Di way VPN dey work be say e go connect your computer or device to di network of anoda organization wey dey provide di service.

    Wen you use VPN, all of your Internet communications dey packaged togeda, encrypted.

    And then send to dis oda organization, where dem go come decrypt, unpack, and then sent am to dia destination.

    So to any oda pesin for di wider Internet, e go look like say you dey browse from inside di organization and not from your location.

    Individuals dey use VPN to bypass local censorship, or defeat local surveillance.

    But di risk wey dey for using VPN be say your privacy no dey guaranteed online.

    Dis na as e be say di organization wey get di VPN fit see everything wey you dey do.

    ICT expert, Akinseyin Kehinde explain say if di organization wey dey provide di service get hidden agenda.

    Dem fit install bug inside your system to gada data, spy on you or take control of your oda online activities apart from di Twitter use. Kehinde add.

    Source link

    Priya Saha
    • Website

    Executive Director at Human Rights Congress for Bangladesh Minorities | Priya Saha is the Executive Director of Human Rights Congress for Bangladesh Minorities (HRCBM). HRCBM is an NGO in Special Consultative Status with the Economic and Social Council of the United Nations.

    Related Posts

    Hope in Ashes: Bangladesh’s Hindus Face a Silent Ethnic Cleansing

    June 18, 2025

    Iraq and NATO convulsions: Christians, LGBT, Yazidis, and failed state | Modern Tokyo Times

    March 27, 2022

    Eric Adams rightly asks NYC blacks to help save their own streets

    March 26, 2022

    The abandoned minorities of Pakistan: Discrimination with impunity, state and constitutional support to the forced conversion, humiliation of Hindus

    March 26, 2022

    Rohingya: Pressure likely to increase on Myanmar after US declaration

    March 26, 2022

    Prominent Balochistan Hindu leader meets Nawaz Sharif CanIndia News

    March 26, 2022

    Spiritual briefing

    March 25, 2022

    Who are the Rohingya?

    March 25, 2022

    How to support working carers in your organisation

    March 25, 2022

    Leave A Reply Cancel Reply

    News Categories
    • All news on Priya Saha
    • Bangladesh ethnic minorities
    • Bangladesh Genocide 1971
    • Bangladesh religious minorities
    • Dalits
    • Featured
    • Hindus attacked
    • Lead Story
    • Opinion
    • Pakistani minorities
    • Plans
    • Politics
    • Religious Minorities-Global
    • South Asia
    • Uncategorized
    Archives
    • June 2025
    • May 2022
    • March 2022
    • February 2022
    • January 2022
    • December 2021
    • November 2021
    • October 2021
    • September 2021
    • August 2021
    • July 2021
    • June 2021
    • May 2021
    • April 2021
    • March 2021
    • February 2021
    • January 2021
    • December 2020
    • November 2020
    • October 2020
    • July 2020
    • September 2019
    • August 2019
    • July 2019
    • March 2019
    • June 2016
    Archives
    • June 2025
    • May 2022
    • March 2022
    • February 2022
    • January 2022
    • December 2021
    • November 2021
    • October 2021
    • September 2021
    • August 2021
    • July 2021
    • June 2021
    • May 2021
    • April 2021
    • March 2021
    • February 2021
    • January 2021
    • December 2020
    • November 2020
    • October 2020
    • July 2020
    • September 2019
    • August 2019
    • July 2019
    • March 2019
    • June 2016
    Categories
    • All news on Priya Saha
    • Bangladesh ethnic minorities
    • Bangladesh Genocide 1971
    • Bangladesh religious minorities
    • Dalits
    • Featured
    • Hindus attacked
    • Lead Story
    • Opinion
    • Pakistani minorities
    • Plans
    • Politics
    • Religious Minorities-Global
    • South Asia
    • Uncategorized
    Meta
    • Log in
    • Entries feed
    • Comments feed
    • WordPress.org
    Facebook Twitter Instagram Pinterest
    © 2026 All Rights Reserved by Priya Saha

    Type above and press Enter to search. Press Esc to cancel.